Facts about Emmuanella

Her full name na Emmanuella Samuel, dem born her for July 22, 2010. She be 10 years old. She from Imo state, wey dey for di south east part of Nigeria. For 2016, she collect award as di best new comedienne and princess of comedy for di Afro-Australia Music and Movie Awards for AustraliaEmmanuella mama no fit hide her joy as she waka around di house wey dem fully furnished. Di post don already get ova 88,000 likes and more than 6,000 comments for her page. Her fans and celebrities hail her for di ogbonge gift wey she give her mama. Akpororo write for di comment section "God bless you little princess ". while musician Sound sultan say Soooo proud of you". anoda celeb Helen Paul tell her congratulation with plenty love emoji.She become popular for her comedy skit "This Is Not My Real Face Oh", wia she dey make jokes about her headmistress to her fellow students without knowing say di student na di headmistress pikin. Still for inside dat same year, she win award for Top Subscribed Creator from YouTube for di first edition of di Sub-Saharan African YouTube Awards. Emmanuella Samuel, na child comedienne for Mark Angel YouTube channel wey get ova six million subscribersShe also get some endorsements for some big brands for di kontri.
v>

Comments

Sponsored post

Kizz Daniel – Lie Lie song by Kizz Daniel

Allyson Felix on the track; U.S. women’s basketball, women’s volleyball advance